One of we beta OAP's for Ibadan, wey dey rep Fresh FM and still win beta award for the last NBMA climb on top her Twitter handle dis morning to share tori of how God use am take save one babe wey some micra drivers RAPE yesterday night come abandon her for express. She say na afta her show for night wey she dey go home she see the babe for express, she say na from Olorunsogo the babe enter cab dey go challenge, before the badt guys do her strong thing, flog her,
collect her properties from her hand, come still RAPE her join. ROLLY say dem take her bra, tie her hand for her back come take her leggings take tie her eyes make she for no see. As many pipu come dey yab the micra drivers, she sharperly add am say na still some micra guys point the babe give dem, meaning say no be all of dem be bad person. She come finish am with advice say make we all dey careful O, especially pipu wey dey stay for Ibadan and say dem don alert police. Weldone babe, you do well.
No comments:
Post a Comment