Thursday, April 7, 2016

ADONBILIVIT... NO MORE FIRST CLASS FOR NAIJA GOVERNMENT OFFICIALS?

OMOBOLA - The presido don stop all the government officials wey dey always travel with first class when den dey go for official mata. Wetin presido talk dey inside one statement wey Festus Akanbi release, media adviser to Kemi Adeosun, Minister of finance. The decision na to reduce money wey dem dey spend on top travel mata by all ministers, permanent secretaries, chairman of federal government committees plus chairman and chief executive. So for now dem say make dem dey travel for business class.

No comments: