Wednesday, September 16, 2015

UI NO FIT COLLECT HALF OF PIPU WEY PASS DEM POST-UTME EXAM O...PEKELE PEKELE

No be small mata o, I don pass exam Godwin...na so, but for U.I., only dat one no go do o cos wen the Oga patapata for the school polongo yesterday dem say na 23,200 pipu score pass 200 for Jamb, na 19,268 come write dem own exam for UI, na 8,992 pipu pass the exam but sha dem no go fit take pass 3,700. Dem go sama scholarship give 5 student wey pass well well...So if you sabi anybody wey write the exam tell am make hin go on top U.I. website go check hin result sharperly.

No comments: