As rumours dey Waka Taiwo Aromokun marriage don scatter, the babe don talk about am O. For one interview wey she just do, Taiwo say na lie O, her marriage no scatter o, she say make we imagine say person just show back to the country O and next thing na make some useless pipu dey spread rumour about am. The actress wey marry Olayemi Lawal, wey everybody sabi as Ogun of Holland, on December 26, 2012 for Lagos. She say she come e Neva pass 2 weeks with her twins. She say she don even do 1 or 2 jobs since he come. She say so she shock when she dey read am say she don even conform am say her marriage don pafuka, she say abeg na who she tell dat one. She say nothing do her marriage O and e no make sense make person dey jump enter conclusion.
No comments:
Post a Comment