Wednesday, March 5, 2014

SHINE YOUR EYES SOME O, SOME BAD BELLE PEOPLE DEY PLAN TO BURST KASALA FOR NIGER-DELTA O.


The Second Oga patapata for Naija Police wey dey Zone 5, Oga Hashiru Argungu don carry mega phone loud am yesterday, say make people for Bayelsa, Edo and Delta State no sleep close dem two eyes o, as den don see vision say some bad belle politicians wan burst kasala for dem area on top the 2015 election matter.


Na for one meeting wey dem arrange with Ogas for political parties and CNPP, Conference of the Nigerian Political Parties, at Bayelsa the Police Oga for loud the mata, and he come tell dem say make den no take the mata do yeye o cos him know say those bad belle politicians get power to cause gobe as dem dey plan.

He come later carry him voice down talk to dem like better people say dem know say if we scatter everything na all of us go suffer am and that kain thing go spoil the better life and safety wey all of us dey desire. So make dem try avoid anything wey no make sense and wey fit cause katakata.  

Na keku Godspower, PDP Secretary for bayelsa come represent him party, Tonye Okio and Joel Tubonimi na dem mark attendance for APC.

No comments: