Tuesday, March 15, 2016

GEORGINA ONUOHA DON DEY SICK FOR 8 YEARS O



Georgina Onuoha wey bin pack go America afta she marry her husband ten yrs ago naim we hear sey she no well o nd e don reach 8yrs wey she don dey suffer from dat disease wey fit kill person. D actress tok sey e no dey easy for her o to dey battle wit d disease, she get two pikin bt she nd her husband marriage bin don Kpafuka. 

Georgina post one picture for her instagram page yesterday nd she tok sey she dey thank Baba God as Him dey protect her since all dis yrs o nd she dey pray sey make dis sickness o, make e kawasaka comot for her body quick. Georgina Onuoha, we for TPN sef dey follow u pray sey make Baba lo 'ke give u good health quick o make u for fit comot for Sutter Medical Center, Sacramento wey dem admit u put....

No comments: