Monday, March 14, 2016

WOW!!!... MOUNT ZION DON READY TO OPEN FIRST 247 CHRISTIAN FILM STATIONS IN AFRICA



I too happy personally as I see dis tori say Mount ZION Films, if you no Sabi dem walahitalahi you no try, whether you be Christian or Muslim,  e no mata. Na everybody watch Ultimate Power (Agbara Nla) Dat year with Ishawuru, Sister Bose, Paulina and Co... Ayamatanga. Tori just yarn us now say like we get Africa Magic,  na so dem wan start Mount Zion TV, wey go dey show Christian movies 247, na him go be the first kain of Dat station for Africa,  and na on top Consat Decoder the channel flip dey and na 1st of May dem dey open am.

Many family no go carry am commot from the station,  I trust. This one make sense GAN,  and I too happy for Pastors Mike and Gloria Bamiloye plus the full Mount Zion family. So make una watch out for the station... Leggo! One day, one day we sef go get we TV. THE PIPU'S TV..... make I follow dem happy so our own too go come sharperly. 

No comments: