Monday, March 14, 2016

LOBATAN... BEN CARSON SAY NA DONALD TRUMP WIN HIM SUPPORT




One week afta he step down from dem Presidential mata, Ben Carson don confirm Donald Trump wey wan compete under Republican Party for Palm Beach last Friday. Dat show say dem don settle dem quarrel, COS dem say everything wey happen Dat time na just politics. Tori yarn us say dis kain thing go really help Donald Trump cos he don still get the support of dem Governor for New Jersey, Chris Christie last month. 


Ben Carson, when he dey yarn say make dem party come together make dem become one cos 'A house divided against itself cannot stand.” He still yarn say Trump no really be as pipu dey see am. He say if e go make sense if him fit be Deputy,  he go like am. He say he don check everything see say na only Donald Trump really get LEVELZ among all the pipu wey wan contest

No comments: