Tuesday, March 15, 2016

IF E NO BE LAI, HE NO FIT BE LIKE LAI- ODIGIE OYEGUN



THE Chairmo of APC, John Oyegun don yarn say e dey difficult gan for dem to get person wey fit be like, Alhaji Lai Mohammed, who be dem former megaphone for APC. Na so Oyegun yarn on Monday after he finish him 10-day working leave. He say the party no dey find am easy to get another megaphone. 


He say e be like say dem don ready to do meeting where dem go for nominate anoda megaphone, he say na person wey go try wan be like Lai Mohammed dem go dey find. The office of dem party megaphone don dey since November when dem make Lai Mohammed, minister of information plus culture.

No comments: