![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjvSm5GkztpfoLTNTr9tJJoQ0S0GWD4ylS7IFpNg9-NgW9D67AIgZQJ7ORpKMaHuQxxFFdBRxej7kD6Ai6cArRhdB1nrEDFzsiysQh-UQY0ONONq5l38a48iUBMsqKrZ8WZGxsR09T2Zqk/s1600-r/HEADER.jpg)
Thursday, September 17, 2015
IBADAN COURT OF APPEAL WORKER CARRY SWORD CUT HIM COLLEAGUE NECK
Na winsh abi na craze? Na the question wey pipu dey ask be dat when dem see say one gardner for Ibadan Court of Appeal carry sword take cut the neck of another staff wey dem dey gather stay for the court quarters. Tori yarn us say the person wey dem dey cut dey clean him own side wen the other gonfabi come piss, na so dat one challenge am say oga no piss for that side again, and na so the guy vex go carry sword take cut him neck. But wetin shock persin be say instead make dem report the mata give police, na the Deputy Chief Registrar call the guy for office, follow am yarn say make he dey go...just like dat. Meanwhile persin wey dem cut him neck still dey Ibadan Central Hospital dey collect treatment. Na so e suppose be?
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment