MISS SIMPLICITY - Na for Lekki Conservation Centre for lagos naim dem for shoot d video, na Frizzle nd Bizzle Films wey don carry many award naim direct d video nd na today d 14th day of April 2016, naim dem go sama their fans wit d video. Tori tok ham sey d video make sense sote Nikki mama wey be Yetunde Laoye sef show face for d video nd dis one no be d first video wey her mama go show face. She bin dey Nikki "Take Sufe" "African Dance" nd "123 video base on sey she support wetin Nikki wey be her only pikin dey do... Before dem go bring d package out, make una see small for wetin dey for d video...
No comments:
Post a Comment