Thursday, May 12, 2016

SEE WETIN MAKE MRS KAUR DEY THANK BABA GOD O


Miss Simplicity - Dis tori dey totori my body base on sey na one country wey I gbadun wella naim d tori take sele. Mrs Kaur wey be d first woman wey go born pikin for old age give her 79yrs old husband naim tori dey tell us sey dem don go back to their house wey dey for Amritsar o
D 70yrs old woman bin get belle afta two yrs wey she don dey use donor egg for treatment nd she born one fine girl pikin wey she call "Armaan" wey mean " Hope or Desire" for English o.
Pipu com bin dey wonda sey wetin go happen to d pikin if d couple kpai o bt


 Mr Mohinder Singh Gill don tok sey dem no dey fear d future o base on sey dem believe sey Baba God go take care of everything... Wow I love dis news, Baba God You too much ooooo nd we for TPN dey sey " Bahut Bahut Badhaaiyaan Mr nd Mrs Singh, Aapko ke Bacche Ke Liye" dat is to sey "Congratulation to you Mr nd Mrs Singh for your new baby oooo...

No comments: