Wednesday, April 13, 2016

MONEY SPENDING...SEE WHO DEY DO PARTY WEY MAKE E-MONEY SPRAY 1 MILLION NAIRA

On Saturday, April 9, 2016, Mike Ezuruonye sister marry and when dem dey do dem couples dance, Five Star Music C.E.O, E-Money climb stage go show dem say him na correct money spender as he follow dem dance,  spray money as him broda dey perform for the wedding. Aproko pipu wey dey there, wey dey take mind dollop am as e dey spray say money wey dem spray dem go reach 1M. Abeg wetin dis guys dey do?  Where dem for dey see money?  Abeg who get Buhari number make I share dis news with am O. Lol....... Bigga boy things.

No comments: