Na with heavy heart we take dey polongo say one of we brodalys, a Comedian wey dey creative and dey focused, don cross the Jordan Neva to come back. Dayo Akinshehinwa wey everybody sabi as Kip Smiling, na him death enter we city come carry am run, the young guy just do the second edition of him unique comedy show wey he dey carry go prisons, wey he call COMEDY GOES TO PRISON. but wetin we fit do pass make we say Thank God say he do something wey we fit take remember am today. So today, Wednesday 13th April, 2016 Ibadan Entertainers, Comedians, Bloggers and OAP's go dey do CANDLE NIGHT take honour our guy. Everybody go gather for SCOUT CAMP MARKET by 6pm to gather move go see him family before we move to pay we last respect. We for TPN follow the family, especially him Papa and Mama and the full Ibadan comedians and entertainers mourn and pray make God almighty be with him parents and console dem. Abeg anybody wey wan come, make dem try wear black and make dem carry cable stick come. Kip Smiling, continue to dey smile till we meet to part no more. For any info halla dis number; 07065961824.
No comments:
Post a Comment