Monday, March 14, 2016

TB JOSHUA ROGER PIPU WEY DEM DEPORT FROM LIBYA 100K EACH



Shebi na some days ago we yarn you say dem deport 172 NAIJA pikins from Libya say dem do many bad things wey no make brain for Libya law. Tori yarn us say Yesterday, 39 of them dey dommot  of T.B. Joshua of The Synagogue, Church Of All Nations (SCOAN) during him church service and he roger all of dem 100k one by one. 

Na the church put the tori for dem church’s official Facebook page and for the post dem say one of the Libya deportees wey him name na Fidelis Onos talk say dem bin don put many of dem for prison for like 1 year for Libya after dem catch dem. He say as dem show for Naija,  na just N6,500 dem share give dem for airport say make dem go find dem family, Dat na why some of dem reason am say make dem go turn Mario for TB Joshua neck for him church Synagogue. He say as dem show na him dem sharperly arrange food give dem, give dem cloth plus medicine. To come kill the mata,  na him dem sama dem 100k each make dem take am hold body. Hmmmm..... E good sha,  but meanwhile #JUSTICE4ALL CAMPAIGN still dey go on

No comments: