Monday, March 14, 2016

GBÉNGA ADEYINKA DEY OVER CARRY IBADAN PIPU ALONG FOR HIM LAFFMATTAZZ



Na wa for this big Bros O, he don take brain plus old man wisdom block the mouth of pipu wey dey criticize am say he no dey carry Ibadan entertainers along for him shows wey he dey do for Ibadan. I don hear pipu say dem no like him style but like I talk am before Bros don vex. This time na over carry along come dey worry dem. He don take style put more Dan enuff Ibadan Artiste on him stage for dis Easter edition of him signature show for Ibadan, Laffmattazz. 
Many of the Ibadan comedians plus musicians wey go dey stage for the show na Peteru, Rapindady, Shete, Arole, Dremo, Bk GMB, Keanzo plus many others I believe. Other legends go come join dem on stage pipu like Daddy Showkey, Adekunle Gold, Bash, 9ice, Seyi Law, Dr. Smile, MC Adele, Lepacious Bose, Tony Tetuila, Olu Maintain plus plenty others and of course the Kings too dey come Ali Baba himself plus Broda mi Dapo, D'Banj, apart from the Ibadan pipu wey I wan go see for the show, no winsh go fit stop me make I no go see broda mi Dapo,  BANGA LEE for just 2k at least for Jogor Center. Boss you do well.

No comments: