Wednesday, March 5, 2014

UNA NO GET THAT KAIN MUSCLE TO HOLD JONA MAKE HE NO RUN FOR 2015 ELECTION- JUBRIL AMINU



The former Oga for Petrol (wey we no see buy for some days now) Oga Professor Jubril Aminu don take time yesterday to warn him brothers, dem politicians for North wey dey reason am say dem wan block Bros J or hold am make he no fit run for this coming 2015 election say make dem bone the mata o, cos their muscle no reach.
 

The Oga say true true anybody get mouth to talk wetin he like as per say democracy no send anybody, but the thing dey pain as as some people go just dey run their mouth anywhere dey talk any how on top matter wey no get head. Say one of that kain mata wey dey pain am for hear na the kain argument wey some of him brother for North dey yarn say our Presido, Bros J no get right to run for 2015 election. He say any of dem wey get mind say he wan stop Uncle Jona, make him no think am say he wan go court, but say make him too just go buy form, make he follow Uncle Jona run for the election.

The Oga say if any of them come get muscle and get mind beat our Presido for the election, then bros J no get option pass make he commot from Aso villa go back to him village, and he say make we no gree make dem deceive us o, all those wey dey talk any how and claim say dem dey talk for politicians from  North dey talk for only themself and wetin dem wan chop. Na when him dey yarn with Vanguard News yesterday he clear the matter.

No comments: