Stephanie Linus marry Linus Idahosa for April 2012 nd Baba God don bless dem wit one handsome boy pikin nd wen dem ask Stephanie for one interview sey hw e be to be mama? Stephanie laff nd she tok sey na very beautiful tin to get pikin o, she tok sey sumtimes u go dey wonda sey na me born dis pikin?
Na my belle dis fine pearl for comot. Stephanie tok sey if u look ur baby innocent face, u go dey force to smile nd thank Baba God for d gift. Make I quote her "Motherhood is an amazing nd wonderful feelings, it's something u cannot describe..." Finally finally she com still tok sey na if u experience ham naim u go know hw d tin sweet reach. Hmmmm, Stephanie Linus don tok ham finish nd we dey pray sey make dat bundle of joy wey Baba God give her o, make e continue to dey bring smile to her nd her family face ooooo.
No comments:
Post a Comment