Make una no vex sey I bring dis tori late, na traffic cause, i suppose don vex go back bt base on who una be nd base on d legacy wey d person wey dey d tori don put for ground, I just try mangae d traffic. Omotola Ekeinde wey bin dey hospital last weekend don comot go her house base on sey she don well.
As her fans dey hapi for her, na so she sama dem wit d picture wey show sey she dey collect award from City People Social Media, na she win d Female Entertainment Personality Award. Nd for d picture she write say 'I don well now o nd I dey my house infact dem don give me award". She com thank God nd her fans wey no comot for her back ooooo. We for TPN sef dey say congratulobia Omosexy, u too much..
No comments:
Post a Comment