Tuesday, March 15, 2016

SEE GROOVE... AS YEMI SONDE DON READY TO BURY HIM MAMA



Yemi Sonde na one big Bros for Radio for South West Naija. He get plenty mouth like kettle,  he get connection, he go school well and he come over Sabi him work. That na why the full Ibadan don ready to stand still for am dis coming weekend,  from Thursday to Saturday. Thursday na visit to Motherless Babies Home,  Friday go be Artiste Night,  where plenty musicians go for show love and pay dem last respect to Mama Obawamiri Sonde for Waniq Event Center wey dey Jericho Ibadan,


  den finally on Saturday go be reception for BCOS ground, Balogun and na Mega 99 go hold mic song Dat day. You say MC nko,  walahitalahi I no know cos MC go dey swallow MC Dat day ni.... Lol. We for TPN say good night Mama.

No comments: