Nollywood actress, Tonto Dikeh wey marry, Oladunni Churchill din finally confirm the rumour say her Guy na pikin if we former Presido, Olusegun Obasanjo. For one kain new interview wey she do with Golden Icons, na for there she yarn say na Obasanjo be her husband Papa.
Dem come ask am if dem don see before, she say yes na, dem don even snap pinshure together and Baba na very wonderful man, na till when she meet a. She Sabi say Baba na correct guy, no be wetin pipu dey think about am. Wetin she talk wey shock me pass be say Baba na very spiritual person, as per say he like God wella. Hmmmm..... I no talk sha.
No comments:
Post a Comment