Friday, March 18, 2016

SEE WETIN OYINBO COURT DO POLITICIAN WEY SHARE CHICKEN FOR ELECTION



Oyinbo sha.. Me be like say dem no like Awoof like us. One Romanian Member of Parliament, Florin Popescu, na him dem court don say make he go do 2 years for prison bcos say he wan become Council leader for the second term in 2012, he come go share 60 tonnes of fried chicken to pipu wey go vote. Tori yarn us say the politician wey him nick name na “Chicken Baron” na him get volunteers wey go help am distribute the chicken. 

Dem own EFCC come see say he don spend like £85000 take buy the midinmidin and dem say that one na abuse of office. Dem say na on  April 5, 2012 na him pipu wey he send message carry the chicken go different area inside van go dey share am give pipu. Na so dem take send am go 2 years for jail without option of make he pay fine money,  even dem throway him appeal. Dat one na after the mata don first make am resign him position last month. 

No comments: