Chaii... Plenty female students wey dey do OAU pre-degree programme don carry injury O as dem Bva hostel go fall. Tori yarn us say many of dem dey hospital and the ones wey no woundjure come dey go sleep inside lecture theater for dis cold. Tori yarn us say na heavy rain plus the wind wey follow am carry roof of dem hostel. But dem rush many of dem go health center go treat dem injury. We still hear say the OAU Pre-degree management don polongo 2 weeks break for the students, so dem go fit rebuild the hostel wey fall. We thank God say nobody kpain.
No comments:
Post a Comment