Na WA O. One tenant, Jeff Obasanjo na him don put fore for the body of him 83-year-old landlord, Pa Joseph Iyen, on top rent mata. The bad thing shele for the old Papa house wey dey between 2nd East Circular road and 3rd East Circular road for Benin.
Tori yarn us say the Baba bin don give the suspect quit notice for 2 different times on top say the gonfabi no dey pay rent, and na wetin dem drag wey make am kpain the Baba be Dat O. When the Papa wife Mrs. Esther Iyen, dey yarn she say e don tey wey the guy don dey threaten dem life. Cos he still no dey pay electric money.
No comments:
Post a Comment