The Caretaker Committee Chairman for Asari-Toru Local Government Area wey dey Rivers State, Mr. Sobomabo Jackrick, na him dem don polongo say dem dey find O. Na so we police yarn afta dem find some plenty weapon for him house on Wednesday, the Deputy Inspector-General of Police wey dey in charge of Operations, Mr. Sotonye Wakame yarn so.
The State Governor, Nyesome Wike na him appoint Jackrich, wey everybody sabi as Egberipapa, wey still be militant Oga before as the Chairmo for the caretaker committee. All dis ones na as dem dey ready for the state for the election re-do wey dem wan do for dem Senatorial elections on Saturday, March 19, the Oga police don yarn sha say police no go gawk am as dem go try protect pipu life and property for the state before, during and even afta the elections. Oga come still talk Salem go soon catch-all the bad pipu wey get hand for the plenty killings wey don shele for the state.
No comments:
Post a Comment