Thursday, March 17, 2016

ON TOP WETIN?.. COURT SAY MAKE 19 YEAR OLD NAIJA GUY GO DO 37 YEARS FOR PRISON



One Lagos High Court on Wednesday don say make 19-year old boy wey just finish school, Tobechukwu Igbokwe go do 37years for prison on top wayo wey he do one American of $40million. Dem show the guy for court on top 12- count charge say he do forgery, conspiracy plus 419. Justice Lateef Lawal Akapo say na true the guy do the 12 tins come send am go prison.

Dem give am 7 years for offence 1-8; 8years for offence 9; 7years for offence10, 8 YEARS for offence11 and 7 years for offence12, everything come be 37years for prison. And all the 37 go dey run one afta the other from October 28, 2013. The court come still say make Igbokwe go return the $40million to the person wey he 419 and government go seize him Toyota Corolla car, wey he get from mago mago.

No comments: