Na everybody sabi say Ghanaian actor, Majid Michel, na badt boy as per the kain things wey he dey do for inside films but the actor wey don happily marry him wife, Virna for 11 years now don dey clear us say him no be Dat kain guy.
Many pipu believe say the guy go too like woman but the man say he Neva sleep with any actress for him life and he never chop yam outside of him marriage. He say he no dey reason all those kain things cos of the respect wey he get for the swear wey he swear give him wife when dem marry. Wetin he come talk wey shock me pass na say babe's no dey eye am o, na who him dey be for inside film dem dey like.
No comments:
Post a Comment