Tuesday, March 15, 2016

NO RUN LEAVE YOUR DREAM.. SKALES DEY ADVISE AS HE POSE WITH HIM MANSION



MISS SIMPLICITY - I bring dis tori to una base on who una be, base on sey d tori dey totori my body, e dey sweet my belle nd base on sey d tori tok of one guy wey be correct hustler, Raoul John Njeng-Njeng wey we know as Skales.D guy wey bin dey sing under BankyW EME label wen he first come lagos don post d picture of d new elele mansion wey him buy for lagos. 
For d picture wey he sidon on top him red Ford for d front of him mansion, Skales write sey, Na me be dis o wey bin com lagos wit only three trousers nd na free motor I follow com bt now I don blow sake of sey I no run leave my dream oo, I dey waka wit d drm anywhere I dey go... Now Skales dey tell pipu sey abeg o "Make una no stop to dey dream o sake of sey sum dreams dey come true.. Ovokwor, levels don change ......


No comments: