Thursday, March 17, 2016

PEKELE PEKELE... SEE WETIN CONDUCTOR DO PASSANGER BLO*OS WEY MAKE DEM PUT AM FOR PRISON




Ghen ghen... Dem don catch one bus conductor for Lagos, Taheed Adekunle, say he scatter John Thomas of person wey enter him bus on top bus money. Tori yarn us say na today dem show him face for Tinubu Magistrates’ Court for Lagos, Prosecutor, ASP Ignatius Okeke, yarn the court say the guy do the bad thing on March 12 about 5:50pm for Ajah Motor Park wey dey  Lagos. 

Okeke say as gbege shele between the accused and one passenger, Samuel Amosun, on top say bus money too high from Ajah to Oshodi, na so he carry vexnation kick Amosun for brokos. He say as dem dey court,  person wey dem kick still dey for hospital with all him Blom blom wey don add weight. Dem say wetin he don dey against Section 171 of the Criminal Law of Lagos State, 2011. When dem ask am nko,  the guy day na true he do am,  na so the Magistrate, Mr Ade Adefulire, say make dem go put the accuse for Kirikiri Prisons till the next time wey the mata go come court, na Dat time dem go come yarn him punishment. He come push the mata till March 21. Vexnation no good O. 

No comments: