Cameroon don carry vexnation talk make dem go kpain 89 members of Boko Haram on top say dem be terrorists, na so the BBC Hausa service reports. Dem finish dem mata for one military court on top all the bad things wey dem don do for the country wey be we neighbor for Naija. Tori yarn us say dem be part of the 850 Boko boys wey dey police dommot on top say dem be badt guys.
And dis go be the first time wey dem go say make dem go kpain pipu since dem introduce new anti-terror law in 2014. Na so Cameroon still say make dem go kpain 22 pipu in 2013. naija wey dem dey affect pass gan, for over how many years now, Neva say make dem go kpain anybody for terrorism mata. Although Amnesty International talk one time say Naija Army no dey carry dem reach court before dem kpain dem and our army say lailai, dem no dey do like Dat. Na lie dem dey lie for dem head. Na only God Sabi the truth for here now.
No comments:
Post a Comment