Thursday, March 17, 2016

CONGRATULOBIA... NEYO AND HIM WIFE DON BORN



Ne-yo wey be American R&B singer, record producer, dancer and actor nd him wife Crystal Renay don welcome their first pikin togeda. Ne-yo bin get two pikin from him ex-fiancee wey tok that time sey she tie her tubes wen she nd Ne-yo decide sey dem no go born again bt now Ne-yo don kawasaka enta Crystal life nd tori tok ham sey dem two love themselves like sey tomorrow no dey. 

Ne-yo wey bin help Mario write him hit single "Let Me Love You" for 2014, naim don tok sey him dey hapi like ant wey fall inside sugar o base on sey Crystal give ham that lovely boy pikin...Hmmmm we sef dey hapi for dem, we sey Congratulobia to dem.

No comments: