Shey una still remember Olajumoke, the babe wey dey sell bread, wey waka anyhow enter where TY Bello for dey snap Tinie Tempah. Tori wey dey reach our hand now say the babe don turn millionaire O. Apart from she don become brand ambassadors to many organizations and everybody sabi say no be beans, na serious money she go rake, that one no join the other little money wey she dey get from other tins.
Na so she hammer N1.5million for one weekend. On Saturday, February 27, Olajumoke dey for Abuja where dem polongo say she don become ambassador for Shirley Confectionery, and she collect pass N1m as ambassador. Still for Dat same waka, owner of Biobak Restaurant Mrs Abiodun Obakin sama her gift of N500k for nothing. I hear say all those wey dey help am no like TY Bello plus others no dey collect one koko from her hand. Wow!!!
No comments:
Post a Comment