![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEiVVtWfPBiKaMeVypwXKMmv8pVextwTaupQxRCyGtCVZXOWvWoTfikTVfxtmrFvhyXXyTJXNrPID2ydzdcR1OQdDPaccaEXAaT1YJTQIKTZ3doU-KCH2n2XSiRLzqlffWH2YHeRmgPW_II/s320/%253D%253Futf-8%253FB%253FU2VuYXRvcl9BYnViYWthcl9CdWtvbGFfU2FyYWtpLmpwZw%253D%253D%253F%253D-738574)
E be as e get o, dem say Code of Conduct Bureau don carry we Senate Presido go Code of Court Tribunal o say the property wey he polongo for dem say he get na lie and apart from dat one sef wetin he say he get no tally with the money wey he dey collect wen he be Governor plus Senator for Kwara State, to come even do pabambari dem say he get account for obodo oyinbo. So make he come explein give tribunal which kain business he do wey give am dat kain plenty money. Toor....I pray make dem treat him f**k up sha.
No comments:
Post a Comment