Tuesday, March 15, 2016

LEVELZ ABI GBEGE... DEM SAY BUHARI SHOE NA $8000




E no easy to be a leader O,  na everything about you pipu go dey shine light put. Na so one PDP member, Deji Adeyanju climb on top social media come yarn say the shoe wey our Oga Sai Baba wear na like $8000. He come dey wonder say no be dis same Baba no fit buy nomination form that year? 


The shoe na him dey Presido leg,  when he wan enter Plane on him way to Equatorial Guinea. Wetin come dey wonder me be say, I look the shoe wella but I no see anything to justify that kain money O,  COS if dem change am finish na well over a million Naira. Abeg how you see dis mata? drop your comment.

No comments: