Tuesday, March 15, 2016

HMMM.... OKADA RIDERS BURN BARABER DIE ON TOP 10 NAIRA CHANGE




The yellow guy, wey dey in his early 30s and from Aku village wey dey Enugu State, na him pipu vex beat die say he be thief. But him Padi still dey argue say the guy na Barber and he no dey thief at all,  say pipu wey kpain am just wicked am ni. 


 Tori say kamala burst between Anigbo and one Okada man on top N10 change, wey he suppose collect. Dem say nobody for the area gree talk about the mata, but wetin tori yarn be say na the Okada man call him pipu as dem dey argue when he dey Halla thief, thief, thief. Na so all of dem gather, carry tire from one vulcanizer and dem put fire for the guy body. chairmo of Abuja Spare Parts Dealers Association, Apo say Okada riders for all the small small communities round Abuja don dey over do,  COS na so dem dey gather hand kpain pipu.

No comments: