Just like how Dangote settle gbege between Olamide and Don Jazzy, former Governor for Anambra State, Peter Obi don dey ready to settle quarrel wey dey shele for dem P Square camp.
Tori yarn us say he pain Obi gan say the broda dey go fall eachother hand for public. Dem say Obi halla the 2 of dem separately on Monday to advise them make dem reason am well O, make dem no go do mistake wey fit spoil dem career and dem family life. But Sha O, the 2 of dem we hear say go follow Obi do meeting for Abuja dis week.
No comments:
Post a Comment