Wednesday, March 16, 2016

PEKELE PEKELE... DSS SHOOT UNIJOS STUDENT DIE FOR WETIN???



Tori yarn us say Hezekiah Paul na student of University of Jos and he dey do him 3 months  I. T for one shop wey dey Ahmadu Bello. And na yesterday one DSS officer shoot am die around 3pm. Tori say the officer come catch one John Dan wey nobody even Sabi wetin he do. As Paul see how the Oga DSS dey carry gun,  na so fear catch am wey make am pick race,  and na so the Oga DSS follow am and when he don near the guy,  he settle down shoot am.  (bloody pinshure dey after dis break o) 


Pipu wey dey around try ask questions make dem Sabi wetin be the guy offence but the DSS guy no answer anybody, An he just Carey the dead body go from where dem rush am to Plateau hospital and na for there the guy cross the Jordan. Now pipu don dey shout say when DOS kain craze go stop for we country cos dem want make dem catch dis DSS killer make dem punish am publicly make everybody see am.


No comments: