EFCC don shine light see plenty money again O, and dem come trace the money wey be, N3.145bn to some private accounts of some pipu wey be members of the PDP Presidential Campaign Organisation. EFCC say the money commot from Central Bank of Nigeria to the account of one company, Joint Dimensions Limited, and na for there e come Waka enter plenty different accounts.
Dem say for inside the money, the Oga of publicity for the organization, Chief Femi Fani-Kayode, collect N840m and na for him Zenith bank account, wey dey with Maitama Branch and get account number 1004735721 on February 19, 2015. Dem say the former Secretary to the Government of the Federation wey still be National Chairmo of the SDP, Chief Olu Falae, collect N100m through one company, Marreco Limited, where he be chairmo. Dem still share am give some other pipu sha.
No comments:
Post a Comment