Tuesday, March 15, 2016

AWWW... MIKEL OBI CELEBRATE 6 MONTH BYDAY FOR HIM TWINS

Chaii... Money good O,  abi wetin fit make persin dey celebrate 6 months byday. I never hear Dat kain thing before but we don hear am now as Mikel Obi and him beautiful Russian girlfriend, Olga dey over happy to celebrate dem twin wey turn 6-months.


 But Sha no be Dat kain parry O,  dem just snap pinshure and put am don social media, wey dem take celebrate. So we say happy byday to OBI twins, abi wetin go be dem surname?

No comments: