We Federal Government don say dem go give jobs plus scholarships to the children of Oga Minister of State for Labour, James Ocholi (SAN), wey kpain for inside accident wey shele for Kaduna-Abuja Expressway on Sunday. Na on Tuesday the special Adviser on top Media and Publicity to we Attorney-General and Minister of Justice, Salihu Isah yarn am. The Oga AGF, Abubakar Malami (SAN), talk am when he go hail the Ocholi family for Kano Estate, Abuja. Dem say dem go give job for Federal Ministry of Justice to one of Ocholi’s son, Aaron. He say the ones wey still small go chop scholarships for dem school levels.
No comments:
Post a Comment