President Muhammadu Buhari don finally gree make dem scatter we NNPC immediately into 7 independent operational units and make dem appoint Oga for the units. Na the Minister of State for Petroleum Resources, Ibe Kachikwu yarn am on Tuesday for Abuja. When Oga dey yarn, he say 5 of the 7 operational units go be for as dem dey do am for other national oil companies. The new units wey dem just create now na, Upstream unit, Downstream unit, Refineries unit, Ventures unit, Gas and Power unit, Corporate Planning and Services unit plus Finance and Accounts unit. The Oga for each unit go be Chief Executive Officers, Dem be Bello Rabiu for Upstream; Henry Ikem-Onih for Downstream; Anibor Kragha for Refineries; Saudu Mohammed for Gas and Power; and Babatunde Adeniran for Ventures. The Group Executive Director wey dey in charge of Finance and Services go be Isiaka Abdulrazaq and the Executive Head for Corporate Services go be Isa Inuwa.
No comments:
Post a Comment