Thursday, March 17, 2016

SEE GOBE O... DEM SAY EKITI STATE HONOURABLE DON KPAIN FOR DSS DOMMOT



E be like horror film O,  when The Ekiti state Commissioner for Information, Youth Sports and Culture, Mr. Lanre Ogunsuyi, polongo today wey be Thursday 17th March say the state House of Assembly member, Honourable Afolabi Akanni, wey dem DSS hold for dem dommot since don kpef for dem dommot O.


.Oga commissioner say although the DSS no let am talk since March 4th, but dem pipu inside DSS yarn dem say he don kpain. According to Ogunsuyi, tori yarn dem say na yesterday night he sick and he kpain dis morning, as DSS no allow am see him family,  him doctors or anyone wey he Sabi. Dem say dem dey wait for DSS make dem come confirm the tori or make dem deny am with evidence say na lie,  the bros stoll dey alive. Lobatan!  Na wa for dis country O, na jeje Fayose siddon him own now o... 

No comments: