EFCC don catch former Oga of the Civil Service of we Federation, Mr Steve Oronsaye on top say he do jibiti wayo, wey we still fit call 419. Na around 5pm on Tuesday dem catch am say he thief money when he dey office as Chairmo of the Presidential Committee on Financial Action Task Force. Na Dat time he go collect N240million from the Central Bank of Nigeria say na for committee work, and him committee members no Sabi anything about the money. Na so he take the money do some personal flexing things O and now EFCC don catch am put 24 counts of money laundering for him neck before one Federal High Court for Abuja.
No comments:
Post a Comment