Tania Omotayo wey bin dey date Wizkid don step up as her level change base on sey she don be ambassador now for one premium hydration, energy and recovery drink wey d name be Last Shot... Tania wey dey hustle nd struggle to be big model, bin don model for Lisa Folawiyo studio campaign 2014 wey dem call "Print Party" nd one high Fashion campaign for Polo Avenue bt now she don port as she sama us wit her pictures for her instagram.
On top d picture dem, she write sey she dey hapi as na her face dem dey use for Last shot now. She com still tok sey Last shot na one drink wey make sense sake of sey if u drink o nd u no want make d tin dey affect u d second day, Last shot go help if u take ham...We hear u Tania nd we dey sey "Congratulobia....
No comments:
Post a Comment