Saturday, February 27, 2016

YEYE DEY SMELL ...SOUTH AFRICAN THE NIGERIAN SAY NA JESUS GIVE AM BELLE

One teenage girl wey get belle for South Africa don say na Jesus give am belle O. The babe say na Angel show for her side, tell am say him na Nephi lie and he carry message come from girl Jesus say she go get belle O, and born boy wey go be Jesus pikin. We Sha sabi say Nephilims na some kain creature wey dem mention inside Bible for Genesis 6:4, na dem arrange some babe's dat time wey make God re-arrange things dat year. As e don tey wey we hear from dem, na him shock everybody for her family when the girl dey yarn her super story. But on to say dem be religious pipu,  na one time dem swallow am, come dey pamper dem baby, wey dey carry Jesus baby. But doctor wey sabi as e dey go, Dr. William Franklin Murphy, say he don hear the tori but he Neva fit confirm. He say from everything wey he don see, the girl belle normal and wetin the girl talk say she no chop yam na true one kain,  but dat no mean say na from heaven dem give am belle,  but the pikin na boy and na after dem born am dem go do DNA test take Sabi who get the pikin.

No comments: