Sunday, February 28, 2016

WE BIBLE PASSAGE FOR DIS SUNDAY FROM FROM D PIDGIN BIBLE OB'S VERSION



OGINNI BERNARD -

Luke 3:10-18
(10-11)As time dey go, people gather con ask jesus wetin we fit do. Jesus con answer dem, man wey get two coat, mke hin share with person wey nor get at all


Man wey get food,mke hin sef share with person wey no get too.(12) Tax collectors dem show ba-ground wey be say dem con baptise con ask 'ticha ticha !!!! (13) Wat of we na!!!  Jesus con answer dem say, no collect pass ya boundary.

(14)Sojos sef dey, dey look dem, small time dem sef ask ' we nko how far na ' jesus still answer dem, no thief frm d people dem n mke una no beat anybody 4 wetin hin no do n mke una salary dey beleful una

(15)People begin look dey  wonder again about John if na hin be d jesus(16).John con answer dem say 'I baptise una with water,  but person wey dey strong pass me by far, get level wey be say I no fit even lose d buckle of hin kito sandals

Hin go baptise una with holy spirit n fire. (17)Con use rake select d wheat dem from d shaft, hin go put fire burn dem d shaft dem.  (18)He begin preach d good news to d people.

No comments: