SISI- Naso I jam my belle dancer Shakira for news o unto say dt km tym wey me still dey learn how to roll waist, na Shakira I take dey learn but as I try reach dat year...omo mehn e no easy O, COS fat wey dey my body no gree mk d waist nd hips come out.... Bt to come see my 'dream belle dancer mentor' still dey roll reach now rolling na good news O, unto say she sabi do every well. Apart from say she don do music for like 23yrs now, she sabi play guitar, different kain drums plus harmonica wella, she come still sabi speak 7 different languages pass pple wey gt am sef. E no end for there O, she don even get her own charity organization wey dem dey call pies descalzos. To come kee me finish I hear say she don become goodwill ambassador for unicef..... na ds one me lyk to dey call continuity, and no mata wetin persin wan do, make he do am well... abeg help me sama am 3big gbosa.

No comments:
Post a Comment