The police wey dey Festac Town and one Oga of Oodua People’s Congress (OPC) for the weekend don rescue one baby way dem put inside indomie carton. Tori yarn us say one OPC Oga for Amuwo Odofin, wey him name be Suleiman Badmus ,who be OPC oga patapata na him hand her over to the police.
Olabisi, younger sister to the OPC Oga, who rescued the baby, talk say dem find the baby close to where she dey sell Agbo for Amuwo-Odofin. She say na one of dem OPC members hear the baby where she for day cry com sama my brother, Badmus.. The woman still yarn say, When she see the baby, say she dey shock say whoever abandon the pikin must be crazy. Mosquitoes don bite her face. Why woman go abandon her own pikin after she don carry the belle for nine months?"

No comments:
Post a Comment