Monday, February 15, 2016

OLAJUMOKE DON SIGN FOR PAY-PORTE O, ANODA ENDORSEMENT DON STILL DEY KNOCK

Bread seller wey don turn model Olajumoke Orisaguna don sign officially to become the face wey one company wey dey sell market online, PayPorte wan take do dem advert for this year on top all dem bill boards. Na today 15th February dem go sign the deal and pipu wey dey there na Olajumoke' Angel, photographer TY
Bello, Jumoke's husband Sunday , Jumoke's lawyer Yomi Adeseyoju , Thisday journalist plus PR Azuka
Ogujiuba, Irene Kayoma, Head-Corporate Strategy/Planning and Noble Igwe brand ambassador for
PayPorte. I even dey smell anoda one coming from one big bank wey tweet @tybellotweets to say dem go like to be part of moving her forward. God bless Olajumoke, God bless TY Bello.

No comments: