Police for Lagos don catch 26 years old, Emmanuel John say he thief him Oga Car wan take buga babe for Valentine parry. Na dem Rapid Response Squad (RRS) catch am after him boss Halla wen she no see her car. The mumu guy move the Toyota Corolla car wey get number Epe 642 DX. He first go photocopy the key bcos he wan carry the car of him Oga Madam, Mrs Floral Ighalo go one groove wey dem call Splash Hotel's Valentine Show on Sunday night. Na so the guy Dodge enter on Sunday wen he no suppose dey work, go move the car, he never return the car wen madam notice come Halla dem RRS, as dem call the guy, him just dey blow down dey come and na so dem take catch am. Na so so beg e dey beg say he just carry the car go groove ni, he no thief am cos madam dey do am well.
No comments:
Post a Comment